NNL group B1 Strugglers Osun United go welcome 3SC wey dey form for their matchday kasala for inside the Nigeria National League (NNL) for the Osogbo township stadium,dis Saturday wey dey come so.
Osun United bin add players wey get experience join the team before season start but things no go well as b4 b4 coachee wey be David Samson Unuanel take plan am the team dey bottom of Group B1 for the 2018/19 NNL season with just one point from 3 games.
The coachee wey pack Im load Waka with immediate effect tok say im players dey purposely lose matches.
Unuanel bin resign as the head of technical crew of the club early dis month after im team fall Yakata to Brillars Giants after dem lose their 2-0 kondo first half lead and the Giants come back to kpokpo dem 4-2 to kolobi the game.
Meanwhile their opponent wey be 3SC only for weekend kpokporise Bayelsa United 3-1 and dis one don give the warriors better confido for the team and the belief say dey for beat any team Don dey.
Even with the New confido level wey Don rise so, Supporters and fans of the Playoffs warriors Don carry advise give the team say make den be careful against Osun United as dem go use everything wey dey get to kpake dis game because of their poor run so far.
3SC dey enter dis derby as table toppers with seven points from three matches, while United dey fifth spot with one point from the same number of games.