Tori say the Gabonese Football Federation (Fegafoot) don begin dey select the person wey go replace Daniel Cousin as their national team coach.
Gist say over 82 coaches, including 14 Africans na im apply for the position to be the coachee of the Gabon national team.
Na for March dem nack Cousin akpako sack sake of say e no qualify Gabon for the 2019 Africa Cup of Nations (Afcon).
Since dem put Vacancy sign early this month, many coaches don sharperly send their application to take kolobi the position wey Cousin leave even the position of technical director dey vacant too.