As the draws for the Afcon 2019 don come and go so, many ex-internationals and presidos of football federations still dey yarn concerning the possible chances of some teams to shock others for the tournament wey go start for June.Â
One of such people wey tok na b4 b4 Senegal star wey be El Hadji Diouf wey believe say Kenya na one team wey go cause problems for the 2019 African Cup of Nations (AFCON) for inside Egypt. E insist say the Harambee Stars na hard nut to crack and say dem don improve wella over time .
Stars dey the same group with he b4 b4 Liverpool star country wey be Senegal for Group C of the June 21-July 19 showpiece together with Algeria and Tanzania.
Diouf tok say the group dey tough. E say Kenya Match against Ghana bin open their eyes to know say dey go be difficult side for Senegal and for the group. According to am e say Kenya dey play good football.
 E Dey expect either Kenya or Tanzania to make am reach the knockout rounds especially as Car don make room for four best third placed teams to progress with did one wey dem expand the tournament .
Diouf bin dey Cairo for the tournament draw and from there Waka enter Tanzania for the CAF Under-17 African Cup of Nations wey dey shele now.