Bayelsa Queens Head coachila wey be Moses Aduku tok say im dey ready to kolobi the top prize for the Maiden Pre-season tourney for women football teams for obodo Nigeria.
Aduku yarn dis one for inside Akure, the Ondo state capital.
E come hail the organizers, come beg relevant authorities to helep join hand improve the standard of women league for Nigeria and Africa.
Bayelsa Queens, Edo Queens, Sunshine Queens and Osun Babes dey part of the team’s wey go follow participate for the tourney for Akure.
The tournament go start March 28 and end on March 31.
For the first game, wey go shele for 4 pm for the Ondo state sports complex, Sunshine Queens FC go face Royaltoms of lagos.