Tori wey dey say if everything go well Clubs and Management of the Nigerian National League wey be the NNL go hold Congress and Draw to carry welcome the chacha season. Dis one go shele dis Wednesday 6th of March for inside Abuja.
The AGM dey give people wey get hand for Naija football for dis level, better platform to sidon and discuss the plans and the programmes wey NNL get for the year.
Media officer wey be Amar Ignis yarn say na for the Congress dem go gree whether the date wey dey on ground wey be the 13th of March go fit stand and the format wey the league go take for the season wey dey come so…
NNL wey be the second tier of Naija football bin adopt the abridged format of four groups -A1,A2 and B1,B2 of ten(10)clubs for each group wey come total forty (40) teams last season.