Mike Archer wey be the General Manager of the Nigeria Rugby Football Federation don React to the fact say dem no elect any Naija person for the Rugby Africa elections wey dem do.
According to am, e say e no really matter say Naija person no dey among those wey dem elect, e say our priority now na how we go take put our house in order.
E say Rugby na game wey dey grow for Niaja and for Africa. E add join say women rugby dey very important and say Naija women get plenty talents and get alot to improve but say their waka for the las vegas Sevens for inside the USA wey dem reach quarter-final after dem play, win 42-0 against New Mexico U, lose 5-25 to Phoenix, narrowly lose 15 -17 to Chicago Lions Black and then finally fall yakata for the quarterfinals to the Rocky Mountains 12-17.
Mike Archer say the results dey very encouraging and dem wan try build the Rugby Women team around those wey go represent for the invitational for America as all of dem base for obodo oyibo but say dem go include home-base wey sabi join.
The people wey dem elect for the Rugby Africa election for Morocco be dis :
Khaled Babbou: Presido (Tunisia)
Andrew Owor: Vice Presido  (Uganda)
Tano Elvis: Treasurer (Ivory Coast)
Jurie Roux: Secretary-General (South Africa)
Executive Committee people na:
Rolande Boro (Burkina Faso)
Aaron Jani (Zimbabwe) with
Clement Sinkamba (Zambia)
Nasser Bougja (Morocco)
Herman M’Bonyo (DRC)
Paulina Lanco (Burundi)
Guedel N’Diaye (Senegal)