April 9, 2019
Super Eagles won’t be considered underdogs at the 2019 African Cup of Nations, but the team will also not be considered outright favorites for the title, Head Coach Gernot Rohr has admitted.
Nigeria qualified for the football showpiece in style; returning after missing two consecutive editions, but Rohr says it’s not lost on his players to stay humble and keep grinding.
In a chat with brila.net he dispelled any notion that the three times champion should be considered darkhorse.
‘No we’re not underdogs, we have a good team and we can hope to go far, but we’re also not the absolute favorites to win the competition.’
After the kpokporisation of Icelandic side wey be UMF Selfoss, Naija Super Falcons no fit repeat the same against fellow World cup bound team wey be Canada for the Pinatar Arena women football festival as dem fall yakata 2-1 for Spain.
Tori wey dey say Canada coachee wey be Heiner-Moller happy wella say dem play Naija as dem get another African for their World cup group E wey be Cameroon and dem believe say dis na another way to carry test their strength and ready for the World cup.
As of half-time Nigeria bin dey lead with goal wey Desire Okparanozie score for the 26th Min but the Canadians come back for the second half with vexation to level up with goals from Janine Beckie(47mins) and Sophie Schmidt (53Mins) to kolobi the game 2-1.
Plenty improvements dey for the Nigerian ladies side but dem still need work to do as dem go jam tough opponents for group A that is France , Norway and South Korea.
Canada wey be number 5 for World bin start their waka against England women and dem kpokpo dem 1-0 and now dem don beat Naija 2-1 to take continue their ogbonge waka for the Pinatar Arena women football festival.
Canada go start thier world cup waka for France against No. 46 Cameroon before facing No. 19 New Zealand and the eighth-ranked Netherlands.
One Hibernian fan wey provoke confront Rangers skippo James Tavernier ontop don go prison for 100 days.
Cameron Mack gree say im breach the peace charge for Easter Road for March and dem don ban am to attend any football games for 10 years.
Cameron bin run from im seat enter pitch before half-time for the 1-1 draw and e come kick the ball throway as the defender bin wan take throw-in and e come dey harrass am before police and stewards come enter the matter.
Sheriff Adrian Cottam tok say the prison sentence na the only way to carry show say society no like wetin im do join the many many gbeges wey don shel